+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Contractor wey nor do road well go repair am himsef

As part of ways to take get value for d tax wen Deltans dey pay wen dey go on top road construction, Delta State Government don talk say any contractor wen do road wen no good go repair am with him own money for three years.

Na the state Commissioner for Works, Chief James Augoye nia yarn dis one for one meeting wen he get with contractors and other stakeholders wen dey handle government projects for Asaba wen be the state capital.

Chief Augoye come dey complain say undermining d big amount of money wen the state government dey pump put for road construction, taxpayers no dey get value for their money.

 

 

Meanwhile, the Commissioner for Justice Barr Peter Mrakpor don talk say d roads wen don caput for state no dey speak well of the state government, he come talk say from now onwards dem go begin deal with engineers when approve those kind roads.

Wen the state Sector Commander of Federal Road Safety Corps (FRSC), Delta State, Mr. Ocheja Ameh come dey yarn, he come beg contractors to dey involve the agency during work construction for the state so dat both human beings and motor go fit dey move well…

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM