Federal High Court for Maitama, FCT Abuja don give foma Govinor of Central Bank of Nigeria, Godwin Emeifele, bail but he go pay N300 million.
Na wey Justice Hamza Muazu dey give di judgement nai he say Emefiele go bring two suretie wey dey stay for Federal Capital Territory and dem get land near di Maitama court, before dem fit release am.
Di judge come fix November 28 to start di full hearing of di six count charge wey Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, put for Emefiele neck.
Before di judgement today, court don already bin tell Emefiele make he drop all hin documents wey he fit take use travel obodo oyibo.
[SA]