+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

War Start Kill And Go For Adamawa Police Headkwata

Pipo wey karey gun enta Adamawa State Police Headkwata early dis morning Wednesday, start to dey shoot wey make pipo wey dey stay for Yola mind don dey for up.

One pesin wey dey stay for Jimeta community for where di police headkwata dey for Yola North, say no be 30 minutes tin nai dem dey tok, as all of dem find where to hide head wey di shooting dey go on.

Di Police Public Relations Officer, SP Suleiman Yahaya Nguroje, come later tell Daily Trust say dem never know di pipo wey come attack dem but dem make sure say dem fight back di gunmen wey dem never know.

One other source say na sojas nai come attack di station cus of say police go kill one military officer.

But police say dem dey investigate to know wetin really bring di shooting dis kind early morning.

All dis dey happen only some days ago wey EFCC and Nigeria Air Force get small quanta as dem bust EFCC office for Kaduna say make dem free their colleague wey dem arrest for wayo mata.

Di tin come make gbege wan bust for di place as di military and security wey dey guard di commission almost do shoot me I shoot you back.

Na later on nai EFCC release statement say make nor bodi feel say dem fit shake dem as long as say na dem work nai dem dey do.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM