+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NAF Jet Bomb Pipo Die For Kaduna

Some pipo for one village wey be Tudun Biri wey dey for Igabi LGA for Kaduna State, afta Nigerian Air Force jet drop bomb as dem dey celebrate Maulud.

Tori never too clear of how many pipo die but one tok say e pass 30 pipo wey don die since 9’oclock on Sunday and e dey don dey be like say di nuba don even high pass now.

One pesin tell from di village tell tori man say di bomb just land for where dem bin gada to celebrate.

“Dem dey do di birthday celebration of Prophet Muhammad wey di bomb just land and more than 30 pipo die,” naso e tok.

Wey dem go meet Samuel Aruwan wey be di Overseeing Commissioner for di State Ministry of Internal Security and Home Affairs, hin nor tok how many pesin die but say govimet go do press conference for Govimet House to tok for di mata.

“We go to about di mata for govimet house cus security meeting go dey later, so make e be 10’oclock today.

For di side of NAF, dem never tok anytin about weda dem jet bomb anywhere or not.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM