+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Bill NYSC N5m To Pay Gov. Peter Mbah

Federal High Court for Abuja don warn NYSC make dem stop to dey say nor be dem nai give Govinor Peter Mbah of Enugu NYSC certificate.

Justice Inyang Ekwo on Monday say all di evidence we dem get show sat di govinor really do NYSC and na dem nai give am certification afta he finish.

Di judge say na mis yarn dey do NYSC wey dem take say nor be dem nai give Mbah di certificate wey he go submit give INEC during govinorship election.

Na rope justice Ekwo take tie NYSC for neck cus dem nor fit bring di two file wey show say Mbah do di program finish. Nai court say NYSC nor serious for di mata.

Mbah face shine for di judgement as court tell NYSC to pay N5 million give di govinor as damage monie.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM