+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Federal Hand Suppose Touch Ground For Isoko– Jonathan Ukodhiko

House of Rep Member for Isoko North and South Federal Constituency for National Assembly, Engr. Jonathan Ajiroghene Ukodhiko say with wetin Isoko Nation dey do for di economy, dem suppose get Federal institution and other federal beta tins wey suppose dey and that na wetin hin go fight to bring.

Na for interview with awa tori pesin for Erawha, Isoko North, nai Ukodhiko take dey tok so as hin dey put mouth for di victory wey court of appeal give am, and hin ready to make Isoko pipo smile just like he promise.

As he dey tok about di victory wey hin get for di appeal court for Lagos, di senator say blackmail nor dey do am anytin for bodi cus he believe God for victory and na so e come be.

He say he focus now na to join hand with Govinor Sherrif Oborewori so that Isoko pipo, Delta and Nigeria pipo go get beta life.

[FD]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM