+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Don Free Emefiele To Go House

High Court for Maitama Abuja don free Godwin Emeifele di foma Central Bank of Nigeria Govinor wey dey for detention since.

For ruling wey Justice Olukayode Adeniyi, give nai he take say make dem free Emefiele give di three lawyers wey dey epp am judge case.

Di judge say no mata how e tay reach pesin wey dey detention must come out and na cus EFCC nor gree bring Emefiele come court for Nov 2 nai make dem give di judgement like that.

Say nor need for di foma CBN Oga to dey for detention wey FG wan still bring am come again for Nov 15.

Justice Adeniyi say di date wey FG lawyers even say dem wan bring Emefiele come court no even dey di same and more over Emefiele don stay 151 days for detention without any trial for court and e nor suppose be so.

Naso court say make dem free Emefiele for he lawyers and make he come court any time wey case dey.

Justice Adeniyi come tell Emefiele make he drop all he travel documents give court until when he go come court again for Nov 17 wey dem karey di case go.

[Vanguard/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM