+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Wan Fly To Saudi Arabia For Summit Today

On Thursday President Bola Tinubu dey ready hin bag to travel go on Riyadh, Saudi Arabia for di  Saudi-Africa Summit on November 10, 2023.

For di statement wey Ajuri Ngelale, di special adviser to Presido for media and publicity, he say nor be karey waka nai Tinubu dey do but na way for am to bring more foreign direct investments for Nigeria.

Di pipo wey go folow president go na Minister of Foreign Affairs, Amb. Yusuf Tuggar; Minister of Education, Prof. Tahir Mamman; Coordinating Minister of di Economy and Minister of Finance, Mr Wale Edun; join with Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Dr Betta Edu; plus Minister of Budget and Economic Planning, Sen. Abubakar Bagudu.

Other wey join for di waka na di National Security Adviser (NSA), Mallam Nuhu Ribadu; Director General of National Intelligence Agency (NIA), Amb. Ahmed Rufai Abubakar; and di Chairman of National Hajj Commission of Nigeria (NAHCON), Mallam Jalal Arabi.

Ngelale say president Tinubu nor go stay long cus as di summit finish for Saudi Arabia, hin go fly come back.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM