+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Die For Bauchi Afta Odeshi Fail Am

One 43 years man, Muhammadu Ali wey dey stay for Damaiwa village for Bursali ward inside Zaki Local Govimet for Bauchi State, done enta one chance for native dokitor charm mericine.

Ali go meet Danladi Ya’u, wey be 28 years native dokitor make he do shot and nor enta for hin bodi.

As dem do jazz finish nai di native dokitor plus four pipo karey Ali enta inside Damaiwa  bush to test di mericine power wey go protect Ali against gunshot.

Na di process dem dey wey Ya’u karey local gun release for shot for Ali but instead of am to stand na ground nai Ali land put.

For statement wey di Bauchi State Police Command release through dem Public Relations Officer, Ahmed Wakil, dem say as police rush reach there wey dem get di info na hospital straight nai dem karey Ali go but hin don already die before dem reach.

As e be now di native dokitor and three other pipo don shele but police hand touch two.

Di PPRO say dem dey do their best to find di ones wey run and proper investigation to deep into di mata.

He say afta dem don finish their investigation na straight to court nai di rest go enta.

[Punch/SA]

 

 

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM