+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Court Don Sack Timipre Sylva From Bayelsa Election

Federal High Court for Abuja don disqualify di govinor of Bayelsa state wey be still di govinorship candidate for APC make hin nor contest for di November election for di state.

Di court say if Sylva contest again e go dey against di 1999 constitution, dis one na afta Deme Kolomo one member for di party karey di mata to court say Timipere Sylva don be Govinor for two times and he don rule for five year.

Nai Justice Donatus Okorowo say yes di govinor nor qualify to run for di election cus of he win and dem come swear am in nai be say Sylva go rule pass eight years.

Di court come use Marwa vs Nyako case of Supreme Court, and ontop of that di constitution don already say pesin nor be fit govinor more than two times and nai be di case of Sylva.

But di tokpesin of APC, Perry Tukuwei, say make pipo for di state nor resin am but make dem support and vote for di govinorship candidate during di election.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM