+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Presido Appoint Fela Durotoye, Others To Be Media Aide

President Bola Tinubu don appoint new five pesin wey go serve for media and publicity directorate office.

Di five of dem na Fela Durotoye wey go dey for di office of senior special assistant to President for National Values and Social Justice, while Mr Fredrick Nwabufo go be di senior special assistant to President for Public Engagement.

Na Ajuri Ngelale, wey be di special adviser to President Tinubu on top Media and Publicity nai announce di appointment on Monday.

Di other three of dem na Linda Nwabuwa Akhigbe, she go be senior special assistant to the Presido ontop Strategic Communications, then Aliyu Audu go be  special assistant to ontop Public Affairs.

Still for di statement Francis Adah Abah is go serve as di personal assistant to President for anytin concern Special Duties.

While di pesin wey go epp Tinubu for commission as di communication adviser na Mrs Linda Nwabuwa Akhigbe.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM