+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Arrest Yahoo Boys For Skales House

Nigerian singer, Raoul John Njeng-Njeng wey everybodi know as Skales, EFCC say dem catch two yahoo boys for hin house.

On Tuesday nai di Lagos State command of EFCC write for demsay di name of di yahoo boys wey dem see for Njeng Lekki house na Udemba Chukwuemeka (a.k.a Jody) and Jamal Jamiu Onasola (a.k.a. Jamal).

EFCC say Chukwuemeka and Onasola crime na say dem use relationship parole take scam pipo.

One report bin come before say Skales dey cause EFCC say dem send officers come he house for nite to disgrace him and he manager.

Di singer say di way wey EFCC just do that nite, dem behave like tiff wey come karey gun, stick cutlass and different tin take break enta he house.

But wey EFCC come dey reply on Tuesday, dem say Chukwuemeka don dey stay for Skales house for two years, then Onasola don only stay for some months and dem say na Skales be their mentor.

Investigation don start and EFCC go soon karey dem go court.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM