+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Delta Judiciary, Troway Yamayama And Face Di Music

Na five mobile courts nai di Delta State judiciary don give go ahead make dem start for di state to punish any bodi wey go against any law of environment.

Hon. Prince Godwin Ejinyere wey be di Director General of Warri, Uvwie and Environs Special Area Development Agency, (WUEDA), nai tok so wey e host di chairman and members of Delta State Waste Management Board, DSWMB for Effurun.

He say di way dis mobile courts go work go different cus dem go make sure say pipo wey dey stay di state folow all environmental law, cus dem go punish anybodi wey dey karey troway yamayama or dey park motor for anywhere wey dem see.

Ejinyere come say e don bin meet di Private Sector Participants, (PSP) to luk for way to make sure say dem manage dirty well for areas wey dem dey manage.

Di Waste Board management still get enough hailing from Ejinyere as dem dey epp karey di mandate of Govinor Sherrif Oborewori well.

He come still tell dem say anytime wey dem want am to do anytin for dem, he go dey available.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM