The Senate don tell oga Presido Muhammadu Buhari again to declare state of emergency on security without any more delay.
The red chamber make d call after Senator Sani Musa wen dey represent APC, Niger East raise d motion based on the way wen bad guys take kidnap students and staff of the Government Science Secondary School for Kagara, Niger State on Wednesday early mor mor.
Musa wen talk say the winchi winchi dem wen kidnap d people nod military uniforms come talk say dem no know d actual number of students wen d bad guys dem kidnap say the school get more than 1000 students.