+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Arrest 48 Yahoo Boys For Asaba

Like 48 yahoo boys nai di Benin Zonal Command of Economic Financial Crimes Commission, don arrest for Asaba.

EFCC on Monday for X, say na on di 6 of October nai dem take catch di yahoo boys.

Wetin EFCC tok be say na different place for Asaba nai dem take catch di boys and na court be di next place wey dem go enta soon.

Di name of di boys na Chinonso Nnemeka, Chidenbere Ekwealor, Emeka Joseph, Emmanuel Onyeka Onyeukwu, Solomon Omojewe, Miracle Ogonnaya, Pius Innocent, Ebuka Odukwe Osita, Godspower Efe, Chinedu Odiaka, Ogbemudia Wisdom, Okocha Nduka, Victor Chukwuma, Ebuka Ohika and  Bright Odinakachukwu,  Benjamin Kennedy, Abariowei Preye, Odinakachukwu Favour, Ofere Oghale, Micheal Okonkwo, Ezeali Stanley Chinedu.

Then, Bolum Ogechukwu, Dortimi Obiagulu Abariowei, Michelle Cyril, Adesioye Ajibola, Emmanuel Omezi Chinedu, Sule Courage, Daniel Samuel, Ifeanyi Nwabor, Igalawuye Ifeanyi Emmanuel, Uwaechue Chinedu Stanley and Eboh Chukwuma, Ezeali James Arinze, Clever Afokoghene, James Power, Azubudike Emeka, Okwuolise Ebuka, Odiete Timothy and Gilbert Nelson, Akaluai Tega, Chibueze Obiozie, Chukwuma Chidimma, Sambo Daibra, Sunday Victor, Favour Ogaga-Oghene, Albert Oluwaleke, Agholor Omobude Simeon and Okeke Chibike.

Di tins wey dem see for di yahoo boys hand na nine expensive motor, three Mercedes Benz GLK 350, Toyota Camry SE, two Lexus RX 350, two Toyota Camry LE,  Mercedes Benz GLA 250 4Matic, phones and laptops.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM