+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Isreal-Gaza War: 12 Thai Don Die For Isreal

12 pipo wey be from Thai nai di kingdom govimet say don die on Monday for di fight wey dey happen between Israel and Hamas.

Di govimet say dem dey try to go karey dem pipo afta tokpesin woman, Kanchana Patarachoke say na di workers of di 12 Thai pipo wey die nai come report di case give di Foreign Ministry.

Patarachoke say na 8 Thai nai wound then di militant karey 11 of dem pesin since di war start on Saturday wey Hamas go attack Isreal.

Di Thai pipo wey dey work for Isreal many reach 30,000 and most of dem dey for di agriculture sector dey work.

Wey di Labour Minister,  Phiphat Ratchakitprakar dey tok for interview, hin say dem don start to dey karey dem pipo from di danger zone.

“Na 1,099 nai don register to come back to house.”

“We get like 5,000 wey dey do labour work for where dey fight take hot.”⁰

Di foreign ministry tokpesin, Kanchana say dem Thai air force plane don dey ready to karey pipo.

E pass 1,100 pipo wey don die for di fight wey start with Israel and Gaza, and Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu don dey tok say na big gbege nai dey for front.

[AFP/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM