+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Use Di Same Hand Take Free Kanu As You Do For Igboho, Igbo Youths Beg FG

One group for East wey dem be South East Youth Leaders, COSEYL, dey beg President Bola Tinubu make hin stretch di same hand wey Benin Republic use take frew Sunday Adeyemo, aka Sunday Igboho, karey reach has Mazi Nnamdi Kanu di leader of IPOB wey still dey with DSS.

Di group say Kanu dey fight for hin pipo di same way wey Igboho dey fight for Yoruba pipo for west.

Di statement wey di group President-General sign for Owerri,  comrade Goodluck Ibem, say dem know say FG hand dey for di freedom of Igboho from Benin.

Dem say: “E don dey open how federal govimet take free Sunday Ighoho from detention but dem still leave Mazi Nnamdi Kanu for one side, wey be say hin dey fight like Sunday Igboho too.

“To come out tok wetin you nor like nor be crime. Na di right wey pesin get as kontri man wey feel say wetin hin suppose get nor dey reach am.

“We know say FG dey tim of how to protect Nigeria pipo and provide for dem and dem know di right tin to do to make peace come back to South East, nai be to free Mazi Nnamdi Kanu from DSS hand just as Court of Appeal don bin already tok.

“Why upandan dey for South East geopolitical zone na cus of di way dem take hold Nnamdi Kanu and the way govimet dey push South East put for one side for tins inside di kontri.

Ibem say federal govimet nor dey try for Igbo pipo na that one even come make dem dey cry for IPOB.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM