+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

EFCC Don Karey Binance Executive Enta Court

Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don karey Tigran Gambaryan di Binance executive wey dem arrest go court.

Federal Inland Revenue Service bin don nack Binance Nigeria with case of say dem nor dey pay tax for dem platform even afta dem dey kolet moni say na for tax.

Naso dem use take catch two of di executives were but bifor dem go say jack, one of dem wey be Nadeem Anjarwalla run komot from NSA hand come remain only Tigran Gambaryan.

Di case now dey for court as EFCC escort Gambaryan enta court premises to hear mata wey dey for dem head.

Small set back wey come dey for di case inside di court as Gambaryan lawyer say hin never read di charge wey FIRS put for hin client head, nai Justice Emeka Nwite karey di case go April 19.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM