+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Man Wey Dokitor Put Pig Kidney To Save Life Don Go Hass From Hospital

Di first man wey dokitors for obodo oyibo karey pig kidney put for inside he bodi don dey recover very well according to di Massachusetts General Hospital.

Dem tok say pigs organs dey okay for human being bodi as dem own and human resemble but dem go still do small tin to make am nor react.

Wetin di Massachusetts General Hospital tok for inside X be say afat two weeks wey dem do di operation for MaRick Slayman, he dey recover well and don ready to go hass to meet jin family.

Di 62-year-old Slayman just dey happy say all di wahala wey hin dey face don finish cus na wetin he don dey pray for years to hapun and na e don be.

Slayman don dey suffer of kidney disease for many years now bifor he come get chance to see pig kidney use to take save hin life.

Di man say hin happy cus other pipo wey dey pass thru di kind problem wey hin get, go get chance take save dem life with pig kidney.

Science pipo don dey do di research for years bifor spray dem even karey pig heart give two pipo but those ones die, until March 16 wey dem do kidney transplant for Slayman, he come survive am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM