+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Come Karey Una Deadi Bodies, Kenya Hospital

Many deadi bodi wey dey for Kenyatta National Hospital inside Kenya dem fit gada all bury if di families nor come kolet di deadi bodi.

Wetin di largest hospital tok be say na 541 bodi nai dey for Dem mortuary and most of dem na children.

Dem come give seven days to di families to come kolet di deadi bodies or if dem kolet letter from court bifor di seven days go finish, di hospital go gada di deadi bodi bury.

Normally di lawy of Kenya say make nor bodi dey leave deadi bodi for mortuary pass 10 days and anyone wey don pass di time go pay extra big moni.

Pesin wey nor fit folow up with all for even land for prison. For six months.

For di names of di deadi bodi wey di Hospital bring out many of dem na children but half of dem na adult wey dem nor fit trace.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM