+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Election Wey I Shift Folow Law Of Senegal — President Macky Sall

One month afta President Macky Sall karey di date of Senegal election go front, na dis Sunday nai dem go come do am.

Wey Senegalese pipo hear say dem shift election, na so dem temperature rise cus na just di last hour nai dem take hear di news, so many come dey fear make coup no go hapun.

Wey President Sall dey tok with BBC hin say notin  like say he dey regret cus di parliament pipo nai bring up some kind tin wey dem dey fear about.

He say all wetin hin do no go out of si law of Senegal and therefore he nor go fit tell any bodi sorry.

Nai di president come still say with di way pipo take karey di election wey dem shift for head just show say hinden agenda dey and even if him wan stay over years he fit do just like other African president but na only Senegal for tell am to komot cus na dem vote am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM