+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No More Obodo Oyibo Travel For Ministers, President Tinubu

For all those Govimet ministers wey dey travel with govimet moni upadan e nor go be so again from April 1, cus President Tinubu don give order to stop all those kind waka.

Inside memo wey wey Presido send hin Chief of Staff Femi Gbajabiamila to write, nai e take say na teree months nai di ban go last and na for any movement wey be outside di kontri.

Dem say if any minister wan travel and di trip dey very important, then two weeks to di time make di pesin go tell Presido first to get approval before e fit travel.

Di memo say all Govimet dey do na to cut down on di moni wey dem dey use run govimet so that dem fit use am put for other place as di economy nor dey smile.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM