+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Everywhere Go Shake If Una Nor Free Ajaero, NLC Threaten

Organised Labour sag dem go enta full strike for di kontri if say police nor free NLC president Joe Ajaero, before today finish.

Na today Wednesday nai police arrest NLC president for Owerri, Imo State, wey hin dey lead workers for protest against Govinor Hope Uzodimma cus he never pay workers and pensioners for over three years and so pipo dey cry of hunger.

For statement wey NLC and Trade Union Congress, , TUC, write, dem tok say na Govinor Uzodimma and the state commisoner of police nai tiff Ajero.

Dem say workers nor fit dey relax for office why dem NLC president dey for one side wey dem hold am down.

Naso dem karey mata put for President Bola Tinubu ear make hin warn Uzodimma to behave well before he turn di state to where jaguda use hand take touch ground.

[Vanguard/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM