+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Fire Alarm Disturb Air Peace Flight

No be small fear nai enta pipo bodi wey dey for inside flight P47193XF as dem dey travel with Air Peace airplane from Port Harcourt to Lagos.

All of a sudden nai di pilot see sumtin for inside di plane dey tell am say fire wan start for inside di plane.

Di company statement say with strong mind nai di pilot start to press all wetin hin know to make sure say fire nor start bifor he jejely land di plane for ground remove all di passengers.

As di plane land nai dem notice say na fake fire alarm nai just dey ring for di plane.

Know say e never tay wey Dana Air wan land for Lagos runway but all of a sudden he jump komot to enta bush, naso FAAN take say make all Dana Air nor dey fly again for now.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM