+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Uncles Wey Flog Girl Cus She Nor Gree Stop To Go Church

Na seven pipo nai police for Ugandan don arrest afta dem gada give their sista pikin beating of her life cus of say she go church and dem don warn her make she nor go di church again.

Di 18 yrs girl name na Shakira Naula and na for social media nai her video start to dey trend as di uncles lie her down dey release 100 strokes of lashes cus she go prayer for one Kadama Prayer Convention.

As pipo start dey complain, wey di pastor Nicholas Kitibwa hear di mata nai he karey di case go report for Kibuku Police Station how di uncles take flog shege banza for Naula bodi.

Wetin di tokpesin of North Bukedi Regional Police, SP Samuel Semewo tok bs say dem don finally arrest di uncles and go soon land for court.

Dem say Naula mama dey work as house girl for Saudi Arabia nai make her leave her pikin with her brodas. But di brodas don dey wan di girl make she stop to dey go church as dem be Muslim.

Di day wey di tin hapun, na alnite nai di girl go, for morning nai di uncles dem go drag her from di church but di pastor say di girl dey sing for church and nor fit komot.

As di brodas karey vex reach hass, na so each of dem give Naula 5-10 stroke of cane as dem pin her down.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM