+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Okuama Killing, Committee Start Meeting

House of Representatives Committee for Defence don start di investigation on how di 17 sojas take die for inside Okuama community plus di burning wey sojas vex burn di village.

No be many of dem nai come out to hear wetin di investigation go tok, but di pipo of Okuama and oda groups bring dem own book of wetin hapun.

Na for Govimet House Annex for Edjeba, inside Warri nai dem take do di meeting.

You remember say na for March 14, nai two majors, one captain, and oda sojas from 181 Amphibious Battalion, take die around di back of Okuama river.

Wey di Hon. Benson dey tok why di committee never go di village to see tins for demsef, hin say dem get know di whole mata first nai make dem dey ask for memoranda.

He say dem don get some and dem dey still wait for odas bifor di committee go do finish.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM