+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Lawyer Wey Don Win 26 Case, Hand Don Touch Am

One fake lawyer wey dey parade hinsef and don even win 26 cases as attorney, dem don catch am.

Dem say Brain Mwenda Njagi don win 26 cases for front of High Court judge, Magistrate and even Court of Appeal judges for Nairobi, inside Kenya before hand touch am.

Wey dem tok how di fake lawyer take register and dey work all dis time, di Law Society for Kenya, LSK say Brain break enta dem portal, see name wey resemble hin own, do some small wayo inside, then put he picture so that he fit use wey no bodi go notice.

As di mata don come out, some pipo for social media dey tok say all di lawyer wey di fake barrister win for court make dem punish all cus dem no do well.

But some say make dem leave am so that he go just face him punishment like that and afta hin finish make di law society take am so that he go work with dem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM