+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Federal Govimet Go Make Nurses Happy Soon – Presidential  Health Adviser

Di presidential health adviser to Presido Tinubu, Dr Salma Anas-Kolo, say make nurses and midwives nor fear as FG dey do all dem best to make sure say dem get beta service for their profession.

Salma-Kolo tok say govimet dey try to resin di issue wey di National Association of Nigerian Nurses and Midwives (NANNM) bring and how dem go take solve am, cus na that way di nurses fit put dem mind for di work.

Know say we bin tell you of how nurses enta Abuja street dey protest di way healthcare nor gud, how mama and pikin dey die anyhow and even dem nor get any beta join with di caging wey dem wan put for their career.

Nor be small provoke di nurse dem dey as di new regulation of nursing council say dem must work two years for Nigeria before dem register with foreign nursing council, plus no enough nurses and other tins wey dey dem mind.

But Salma-Kolo, don epp Govimet tok say dem dey try their best to increase healthcare for di nation.

He say dem nor tot troway nurses and midwives for one side cus na dem dey stay with patient pass any other pesin for hospital.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM