+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Student Kill Neighbor Cus of iPhone

Di krase to get tins wey order pipo get too dey enta some pesin eye as that one nai be di case of 21 yrs Olubodun Sanni, final year student for Adekunle Ajasin University, Akungba (AAUA), wey kill hin skool mate,  Miss Adekunle Adebisi Ifeoluwa cus of iPhone.

2nd of dis month, February, nai pipo see say Ifeoluwa don die for her off campus hass

Ifeoluwa nai 300 level nai she dey for Economics department before Sanni go use knife shuk her before he tiff her iPhone XR.

Di commissioner of Police for Ondo state, Abayomi Peter Oladipo, say na wey dem notice say di deadi bodi phone dey miss nai dem come dey luk for am.

Di CP say wey dem trace di phone nai dem take see am for Sanni hand wey dey stay di same hostel with Ifeoluwa.

Na wey dem come dey ask am kwestun nai Sanni take tok how he take kill di poor girl.

Police sha don ready to karey Sanni go court afta investigation.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM