+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG Don Start To Take Teachers For Build-A-Thon

Di Ministry of Communications, Innovation, and Digital Economy don announce on Thursday say dem don start Build-a-thon teaching initiative program.

Dem just start di program afta govimet launch am for early December.

Wetin Bosun Tijani di Minister of Communication, Innovation and Digital Economy tok be say, di idea go make students wey dey for senior secondary skool sabi technology quick.

He say na four days nai di program go run from January 2024 and na 1,500 students dem dey expect from 150 skools for teree place, Owerri, Maiduguri, and Abeokuta.

Na for X nai di ministry take dey call on teachers wey know say dem dey qualify to apply. And di real candidates go get eye for education, be teacher and karey beta mind wey go fit epp di next generation of tech for secondary students.

Pipo wey qualify di ministry say make sm go apply for di program website.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM