+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

FG go Start Food Distribution Again Afta Di First One

E don dey clear again say Nigerian Customs Service go soon start to distribute food items, if Federal Govimet don put tins in place.

NCS bin stop to distribute food wey dem seize cus of wetin hapun wey sum pipo die for Lagos State as jaguda boys just come scatter di way dem take plan tins.

You go remember say na FG nai tell Nigerian Customs Service make dem start to sale rice, beans and other tins to epp reduce di rate wey pipo take dey cry for hunger.

Na to make di process work well di NCS for Oyo State say dem go soon start di process again afta govimet don tik of di right way to go about di process so dat no bodi go for or get wahala again for di cheap food.

Wetin di Area Controller of Ibadan Oyo/Osun Command, Ben Oramalugo tok be say “Once dem don put.allndi tire tin in place, dem go start to distribute di rice wey dem seize again. And dem go dey give update on di process.”

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM