+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Men Uproot Warehouse For Abuja, NEMA Say Nor Be Dem Get Am

E clear say hunger dey show pipo shege banza for di kontri cus with di many protest from groups, NLC come join, with di recent one wey hapun for Abuja for warehouse wey govimet take dey store food.

On Sunday afternoon nai video start to fly upandan say pipo don ransack di warehouse wey National Emergency Management Agency, NEMA take dey kip food.

Di way pipo take stum di warehouse dey karey rice, beans, any kind food wey dem hand touch, plus say dem scatter di warehouse make di video dey every where.

As NEMA see di video and wetin hapun for di warehouse, nai dem drop dem update for X on Sunday say nor be dem get di warehouse wey pipo break to karey food stuffs.

Di warehouse na Agricultural and Rural Development wey dey for Dei-Dei inside Abuja nai kontri men go uproot according to Zakari Aliyu di tokpesin of ARD.

But so dat dem wey be NEMA nor go cry I die know tomorrow di Director General Mustapha Habib Ahmed don give strong order to di Zonal Oga and Head of Operations to make sure say security tight kakaraka for all dem facilities wey dey d kontri.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM