+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New Minimum Wage, Wetin Dey Sup?

Belle don too bitter Nigeria Labour Congress say all di tok wey dem dey get with Federal Govimet nor dey get head and tail cus FG never still stand on agreement wey dem get.

To epp make matas nor worse pass as e don be with di everyday strike FG wan do nationwide public hearing with Labour, make dem know how much go be new minimum wage.

Na for di six geopolitical zones wey dey for di kontri nai dem go take do di hearing according to di Federal Ministry of Finance for inside statement.

Di zone na Yola, Kano, Abuja Uyo, Lagos and Enugu and na March 7, nai dem go take do di meeting so that different idea go come togeda make dem see way forward.

Di govimet representative and labour pesins wey go dey di public meeting na Edun and Osun Govinor Adeleke Ademola, dem go stand for other state govimets.

Why those wey go represent employers na Omo-Lamai Grace (Manufacturers Association) and Muhammed Nura under Nigeria Association of SMEs.

Then for Labour na Adeyanju Adewale (NLC) and Shuaibu Afusatu (TUC) nai go rep, join with Labour and Employment Minister of State Onyejeocha Nkeiruka

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM