+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fire Roast Bunkery Pipo For Imo State

Na goat smell nai full di air for di whole Imo State as tanker wey bunkery pipo take dey load oil for Obitti forest inside Ohaji/Egbema LGA don roast many pipo die.

Wetin tori paper tok be say na on Tuesday nai di fire take start for Ndorama Pipeline wey dey for Obitti Rubber Estate inside Ohaji/Egbema.

Video for social media wey dey waka upandan, one pesin wey karey eye see say, “Pipo come bust pipeline. Dem dey call dis place Ndorama Pipeline,” na wetin di witness tok.

E say dem drive enta di place come dig to find di pipeline, as dem see am naso dem start tapping put for di tanker wey dem park for bush.

Before you say jack, wetin cause fire nor bodi know but everywhere don burn and many of di bunkery pipo wey dey use hose draw fuel burn to ashes.

The State Police Public Relations Officer, ASP Henry Okoye, don even confimate di fire and say di commisoner of police for di State, Aboki Danjuma, don set up investigation team wey go still catch di other bunkery pipo wey dey run.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM