+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Stop To Call Nigeria Yahoo Pipo –Presido Tinubu Beg World Pipo

Presido Bola Tinubu don dey ring bell for world pipo make dem nor dey tag Nigeria man and woman say dem internet tiff and yahoo yahoo.

E say that kind name nor gud as e just dey tok bad and stain di white shirt of other pipo wey dey stay for di kontri.

Na wey Presido Tinubu dey move for France as hin go visit dem bai e take dro di bomb. He come say even with di way world pipo take dey blast di kontri e nor still dey kill di kontri man spirit.

Presido come still back Nigeria say dem sabi work and di while world know dem say anywhere Nigeria hand enta weda na medicine, AI dem dey do well so make di bad eye stop.

Even di Deputy President Kashim Shettima, wey hin dey read oga Presido Tinubu speech, he say all di tok wey dem dey vkast Nigeria a out internet wayo say e high fir di kontei maks dem bring proof to show am.

For year 2020 nai FBI put Nigeria for nuba 16 kontri wey yahoo yahoo full pass. And even Nigerian Communications Commission say yahoo yahoo dey make di kontri lost $500 million every year.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM