+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Flood Don Karey Pipo For Ughelli Troway One Side

No be small water don show pipo wey dey stay for Ughelli North LGA shege afta di rain wey fall from Thursday nite go enta Friday morning, July 31. Cus pipo wake up to see say dem dey float ontop river.

Di places wey di water touch na Delta State High Court for Agbarho, Orhokpokpor, Ehwere, Ughrwughelli, and Oviri kominiti. As di pipo dey say ba cus nor guta for di area make di flood dey always come every year.

No be small vex dey pipo belle cus all dem property dey float for water even one trader for di area say her moni don go down for di water cus all her goods don spoil.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM