+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Foma Cote d’Ivoire President Wan Contest As President Again

Foma President of Cote d’Ivoire Laurent Gbagbo  wey first get issue about for 2010 about election wey he nor gree cus dem win am, say hin go run again as president for di 2025 election.

Gbagbo don first found one party wey be Ivorian Popular Front but pipo come kolet am from his hand wey e dey prison for Netherlands till he come back for 2021 come do anoda party wey be Africa People’s Party.

Na di tokpesin of di party Katinan Kone nai tell say afta dem meeting on Saturday nai Gbagbo take say hin wan come out as president again.

For 201 nai case enta di foma president head say na him cause civil war for di kontri cus he nor gree say dem win am for election, but 2019 nai International Criminal Court say he don free from di case before Gbagbo come return from Netherlands prison to Cote d’Ivoire for 2021.

Di 82 years man wey dey rule now, President Alassane Ouattara never tok if hin go join for di presidential race for next year.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM