+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Free Di 313 Pipo Wey Una Call Terrorist, Court Order Army

313 terrorist wey Nigerian Army arrest come send dem to court, table don turn as one Federal High Court for Borno say make dem free di terrorist.

With wetin di Defence Director of Media Operations, Major Gen. Buba Edward tok for court, nai e take tell say make dem free di suspects cus no enough evidence show say dem be terrorist.

For press briefing wey di Defence Headkwata do for Abuja today, nai Edward take say with all dem investigation wey dem show di court, di court say di evidence nor karey water.

He say wetin dem next plan be na to karey di pipo put for Borno state govimet hand, make dem so wetin dem fit do.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM