+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gabon President Wey Dey House Arrest, Wife Don Enta Prison

Di wife of president of Gabon wey military don komot, Ali Bongo, dem don arrest her afta her husband don dey for house arrest for some time now.

Lawyer Francois Zimeray tell AFP on Thursday say na for nite on Wednesday nai Sylvia Bongo Ondimba Valentin say dem take arrest her cus of tiff monie.

For September 28 with nai dem bin charge Bongo wife say she tiff monie, dey do wayo and forge some kind documents.

Sylvia don bin dey house arrest for Libreville afta military catch her husband come take over as president.

Di military coup pipo bin don accuse di foma president of playing wayo for election and since 2018 wey he come get stroke na di wife take over dey manipulate am.

[AFP/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM