+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ganduje enta Soup As Kano Govimet File Case Against Am

Di Govimet of Kano State don Navi akpako onto di present APC National Chairman and foma govinor Sherrif of Kano State, Abdullahi Ganduje say hin kolet w whole $200,000 from one contractor.

Na Kano Hight court nai di case sitdon put with  Ganduje, Hafsat Umar, Abubakar Bawuro, Umar Abdullahi Umar, Jibrilla Muhammad, Lamash Properties Limited, Safari Textiles Limited, and Lesaga General Enterprises wey go come tok weda dem see moni chop or not.

Di Govinor for di state now, Abba Kabir Yusuf also still use di old video from 2018 wey Gaduje dey kolet dollars of over $210,000 hide put for hin agbada  thru one contractor agent wey dem say dem wan foe chance di look of Kantin Kwari textile market.

Wey di video dey trend that year, Ganduje and hin padis dem say na fake video as nor be hin dey inside.

Tori pipo dey try to hear from di Attorney-General of di state, Haruna Dederi, but hin never ansa.

Di mata be like say e go strong for di APC Chairman cus 15 witness plus even bank pipo say dem go tok for court wetin dem know concerning di state moni and di foma govinor.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM