+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Togo Shift Election Cus Of New Constitution Change

Afta di bill wey Togolese parliament sign to change dem condition e don dey bring too much tok sotay dem don karey election wey suppose be for April 20 go front.

Know say e never tay wey di lawmakers for Togo all of den sitdon gree say dem go change from presidential to parliamentrt system of govimet.

Di new law come dey put fear for pipo mind say President Faure Gnassingbé nor go wan gree komot from seat again, opposition come dey urge pipo make dem nor gree for di law.

Cus of di many tok, President Gnassingbé nevwr for sign di bill and he dey wait for some consultations to finish first.

Wey dem wan take do di election na never clear and even sef Catholic Bishops wey dey for Togo still dey put am for di president bodi make e nor gree sign di bill.

Di president don karey di bill go give di lawmakers make dem read am again for di second time bifor he know next step to take.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM