As Govinor Sherrif Oborevwori to see Warri Stadium on Tuesday he nor too hapi with di kontractor cus pf di way dem dey slow even say dem don kolet moni.
Govo say di hagrimet na for December but na for April di work still dey far, he sha greet dem for di playball grand but say di oda tins nor dey standard riech.
President of Nigeria Football Federation, Alhaji Ibrahim Gusau, wey folow still say he like di ball pitch but say with wetin dey grand na September di stadium go ready and dat time Nigeria national football team go don fix march.
