+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Gov Of Florida Stamp Trump For USA President

As di election for di United States of America go soon reach and pipo eye don dey for wetin go shele, Govinor Ron DeSantis of Florida don use e stamp press for Donald Trump to be President.

Inside One 4:32 seconds video nai Ron take say hin stop e campaign and go use all e pawer to take support Trump di Republican candidate.

He tok for di video say, “I don stop my campaign to make sure say I fit deliver give Trump and today I dey happy say I don deliver di promise, and that one nor go still stop me.

“E clear say many of Republican primary voters wan make Donald Trump come again.

“Trump big pass Joe Biden. Dem nor dey drag that one. I don sign to support di Republican nominee and I go stand by that pledge. He get my backing and we nor fit go back to di old style of Republican guard.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM