+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Government dey tackle power mata-Omo Agege

Deputy Senate presido Ovie Omo Agege don talk say the completion and commissioning of the 1.35 KW Solar Hybrid power solution wen the Rural Electrification Agency REA tidy for the Federal University of Petroleum Resources Fupre na part of efforts by the federal government to tackle power situation for Naija through renewable energy.

Wen Omo Agege dey yarn dis past weekend during the Commissioning ceremony for the University campus for Effurun, he come talk say with Solar Hybrid solution, the kians go come fit dey do more research and dey carry out their constitutional mandate for the oil and gas sector.

Wen the Vice Chancellor of Fupre, Prof Akpofure Rim Ruke come dey yarn, he come hail the Federal government for the Power Solution den he come talk say the kians no go only maintain am but say dem go work to increase the capacity say the school don go far for d area of mitering.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM