+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Grammy Give Burna Boy Stage To Perform For 2024 Award Nite

Singer Damini Ogulu, aka Burna Boy, go sing for 2024 Grammy award wey go happen on Sunday, February 4, for Crypto.com Arena for Los Angeles, US.

Na di Recording Academy nai use dem hand take announce am on Monday, January 22, say di Burna Boy go sing for stage with pipo wey popular like dem Luke Combs and Travis Scott.

For dem official X handle nai di Record Academy take drop di message dem say: African Giant @BurnaBoy go take #GRAMMYs stage on Sunday, February 4th around 8 PM ET / 5 PM PT for @CBS.”

Burna Boy don bin get three different nominations for di 66th Grammys.

Wetin dem nominate for na Best Melodic Rap Performance for ‘Sittin’ On Top Of The World,’ Best Global Music Performance for di song ‘Alone,’ and Best African Music Performance for ‘City Boys.’

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM