+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Don Write Pass 252 Songs For My Colleagues

Song writer and singer Tobechukwu Victor Okoh, aka Peruzzi, say make pipo nor look am down cus hin be god for di entertainment industry.

Perruzi say him don write more than 252 songs for different celebrities wey contact am for work.

Na for hin verified X handle nai the song writer take dey call he sef Oracle of music writing mata.

“I don write pass 252 songs for dis industry, so get am for your head for those wey nor know and you just dey play with your papa for this app

“Ask your favorites. Ask your gods. I be oracle. Na dem dey call me. Get sense.

“Industry wey na thief full am. I go talk soon. I go soon do interview when I finish with Sabali.”

Naso Peruzzi say make fans wey dey do other side nor dey look am ayanyan.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM