+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ibori Daughter Win Election Case For Court

Court of Appeal for Lagos don put stamp of seal for di election of Ibori-Suenu Erhiatake di PDP rep member for Delta State.

Di rep member win Ben Rolands Igbakpa of NNPP and Mr Halims Ahoda of APC for di election to be honorable wey go represent Ethiope Federal Constituency.

Di judgement wey  by di three judges,  justice Festus Ogbuinaya, Senchi, and Waziri give on Tuesday just favour foma govinor Ibori piken.

Di court say di appeal wey di PDP member bring come get weight and na so dem take look am and stamp say na Erhiatake nai really win.

As bodi dey sweet di honorable, she come dey salute di court as dem nor troway democracy for ground.

She come still karey di victory wey she get for court take give God and pipo for her constituents, cus she don bin tell dem to mellow down and see as victory go come dem way.

[Vanguard/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM