+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

I Kill My Papa Cus He Dey Turn Bird For My Dream, Kaduna Boy

Kaduna State Police don catch one David Felix wey come from Madakiya village inside Zangon Kataf LGA cus hin go kputalize hin papa.

Dis guy na just 20 years and police arrest am cus hin say di papa dey come e dream as bird for nite to disturb am.

Na for September 30 this year nai David wake up from sleep, karey motar pikin take nack di papa head for sleep.

Wetin di tokpesin of Kaduna police, ASP Mansir Hassan tok be say, even di boy say he really kill he papa and dey regret why he do so.

According to Hassan, dem don start investigation and afta then David go dance for court to di music wey he don play.

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM