+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NLC, TUC Stop Nationwide Strike, Tok Way Forward

Di strike wey Nigeria Labour Congress and Trade Union Congress declare cus of di kposing wey jaguda boys give dem president, Comrade Joe Ajaero for Imo State, dem don suspend am.

Na yesterday nite for Abuja nai afta emergency meeting with di National Executive Council, NEC, and leaders for NLC and TUC nai dem take come to di conclusion.

Na one pesin wey dey inside di meeting nai open up and say di resin wey make dem suspend am, na make dem tok to know di way forward.

He say na cus of FG wey tok through di office of di National Security Adviser, NSA, nai make dem suspend di strike.

Yesterday NSA bin come out to beg di Labour make dem nor vex for how jaguda go beat Ajaero, say dem don arrest some and investigation dey on top di mata.

Part of wetin di source tok na, “He tell us say that kind gragra style nor follow and dem nor go allow am. We know say die strike dey bite govimet cause on Wednesday worse pass Tuesday own, and sign dey show say today own for bad pass.

 

“So, govimet nor want make e worse pass as e be as tins don already kaput for di economy wey dey shake with many problems.

“For awa own side, we blame di labour minister wey dey for di meeting with minister of state for labour, cus dem nor fit stop di strike. We tell am say if hi bin tok, maybe we nor for dey where we dey so.”

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM