+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tanker Drivers Say Dem Go Strike If…

Di pipo wey dey drive fuel motor for Nigeria wey be Petroleum Tanker Drivers (PTD) say dem go komot from Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas (NUPENG) if Williams Akporeha kwatinue to be dem president and Afolabi Olawale dem Seketary general.

All dis one na for inside statement wey one Gbenga Olawale, foma official for PTD, Ibadan depot, nai say if dem nor ansa wetin dem dey ask for na straight to strike.

Di statement say make all PTD members for di kontri put green leaf for front of dem truck as dem dey drive, make e serve as warning to NUPENG and police not to dey do dem anyhow.

Olawale say Williams nor be dem pesin for NUPENG but dem just push am put for petrol station workers of NUPENG (PSW) so that hin fit contest for NUPENG.

He say di union nor fit allow pesin wey nor be worker or even dey sell fuel for filling station make he come.be dem president.

Wetin come still dey di statement be say Williams dey use pipo kolet monie wey dem nor dey use take develop di union or workers but na dem pocket e dey enta.

He say e beta make dem do anoda election and pipo wey dey dem mind for president and seketary general for PTD na Lucky Osusan and Dayyabu Garga.

Olawale say na cus Osusan and Garga don suffa for di union to make sure say dem nor dey karey kolet monie from workers nai make dem drivers stand by di two.

[SA]

 

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM